X


E get dis restaurant wey Apors dey chop for Warri. One oyibo dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish, him go dey shout “hey!!!”, so Apors wonder wetin dey make am shout. Aporscum decide to chop wetin the oyibo dey always chop, so maybe himself go shout too. When he reach d restaurant last week friday, he order wetin the man dey chop, dem tell am say na chicken and red wine, so he chop am. He surprise say he no shout, he even collect extra plate, but still no shout. Na then he just vex ask for him bill. The waiter tell am say one plate of chicken and red wine na N45,000, and the extra plate na another N45,000. Na then Apors come shout heyyyyyyyyy!heyyyyyyyyy!! heyyyyyyyy!!! heiiiiiiiiiii!!!!Untill he reach house he still dey shout.

Simple

Post a Comment

0 Comments